Fela Kuti — Authority Stealing Vocal

Authority stealing! You be thief (I no be thief) You be rogue (I no be rogue) You dey steal (I no dey steal) You be robber (I no be robber) You be armed robber (No be armed robber) I no be thief (You be thief) I no be rogue (You be rogue) I no dey steal (You dey steal) I no be robber (You be robber) I no be armed robber (You be armed robber) Argument, argument, argue (Argument, argument) Them argue (Argument, argument) Everbody dem argue (Argument, argument) Them dem dem argue (Argument, argument) Up and down them argue Everbody dem argue Them dem dem dem argue Yes yes, them argue Everbody dem argue Argument about stealing Somebody don take something Wey belong to another person Then you go hear: You be thief (I no be thief) You be rogue (I no be rogue) You dey steal (I no dey steal) You be robber (I no be robber) You be armed robber (No be armed robber) I no be thief (You be thief) I no be rogue (You be rogue) I no dey steal (You dey steal) I no be robber (You be robber) I no be armed robber (You be armed robber) Argument, argument, argue (Argument, argument) Them argue (Argument, argument) Everbody dem argue (Argument, argument) Them dem dem argue (Argument, argument) Argument about stealing Somebody don take something Wey belong to another person On top of the road, on the side People dey waka Office workers, labourer workers, workers' workers Them go dey waka Inside bus them go dey Motorcycle them dey ride Plenty, plenty crowd Inside this crowd Sometimes for one corner Sometimes for one street You go dey hear: ha ha! Thief, thief, thief! Rogue, rogue, rogue! Robber, robber! Catch am, catch am! Thief, thief, thief! Catch am, catch am! Rogue, rogue, rogue! Catch am, catch am! Robber, robber! Catch am (Catch am, catch am!) Pull am (Catch am, catch am!) Get am (Catch am, catch am!) Keep am (Catch am, catch am!) Ole... (Catch am, catch am!) Catch am, catch am! Looking go start Watching go start Chasing go start Somebody go dey Wey them go grab Them go beat am well-well (Catch am, catch am!) Them go lynch am well-well (Catch am, catch am!) Police go come well-well (Catch am, catch am!) Them go carry am go court (Catch am, catch am!) Them go put am for jail (Catch am, catch am!) Them fit put am six months (Them go put am for one year) Them fit put am two years (Them go put am for five years) Them fit put am seven years (Them go put am for ten years) If not them go shoot am well Them go shoot am for armed robbery On top of the road, on the side People dey waka Office workers, labourer workers, workers' workers Them go dey try To try to make ends meet Them go dey hustle To try to make ends meet Them go put hands for back To try to make ends meet Them go dey beg oga To try to make ends meet Them go be slaves for them town To try to make ends meet Oh yes them go they try Them go they hustle I say turn your face small To the right wing Oga patapata dey for there Authority people dey for there Instead of workers We have officials Instead of buses Them dey ride motor-car Instead of motorcycle Na helicopter Instead of them waka Na worker go waka for them Authority people them go dey steal Public contribute plenty money Na authority people dey steal Authority man no dey pickpocket Na petty cash him go dey pick Armed robber him need gun Authority man him need pen Authority man in charge of money Him no need gun, him need pen Pen got power gun no get If gun steal eighty thousand naira Pen go steal two billion naira You no go hear them shout (Thief, thief thief!) You no go hear them shout at all (Rogue, rogue, rogue!) You no go hear them say (Robber, robber!) You no go hear them say response at all (Thief, thief thief!) You no go hear them shout (Rogue, rogue, rogue!) You no go hear them shout at all (Robber, robber!) [?](Thief, thief thief!) You no go hear them say (Rogue, rogue, rogue!) You no go hear them shout (Robber, robber!) [?](Thief, thief thief!) You no go hear them shout (Rogue, rogue, rogue!) You no go hear them tell you what (Robber, robber!) (Thief, thief thief!) Na different way be them way Na civilize style be them style (Yes, yes, yes, yes!) "Oh yes, of course, contract, have some money back in hand, ha ha" (Yes, yes, yes, yes!) Hear the words them dey take deceive the people: (Yes, yes, yes, yes!) Misappropriation (Yes, yes, yes, yes!) Maladministration (Yes, yes, yes, yes!) Nepotism (Yes, yes, yes, yes!) Mitigation (Yes, yes, yes, yes!) Make I remember another one wey them dey use (Yes, yes, yes, yes!) Defraudment(Yes, yes, yes, yes!) Forgerylization(Yes, yes, yes, yes!) Embezzlement (Yes, yes, yes, yes!) Vilification (Yes, yes, yes, yes!) Mismanagement (Yes, yes, yes, yes!) Public inquiry (Yes, yes, yes, yes!) Authority stealing pass armed robbery (Yes, yes, yes, yes!) We Africans we must do something about this nonsense (Yes, yes, yes, yes!) We say we must do something about this nonsense (Yes, yes, yes, yes!) I repeat, we Africans we must do something about this nonsense (Yes, yes, yes, yes!) Because now authority stealing pass armed robbery (Yes, yes, yes, yes!) Authority stealing pass armed robbery (Yes, yes, yes, yes!) Authority man him go dey steal (Yes, yes, yes, yes!) Public contribute plenty money (Yes, yes, yes, yes!)


Other Fela Kuti songs:
all Fela Kuti songs all songs from 1980