Fela Kuti — Confusion Pt. 2

When we talk, say confusion Everything out of control When everything out of control He go say he pafuka When we talk, say confusion Everything out of control When everything out of control He go say he pafuka Dem be three men wey sell for roadside-o Dem three speak different language-o Dem speak Lagos, Accra, and Conakry One white man come pay them money-o He pay them for pounds, dollars and French money-o For the thing wey he go buy from them He remain for them to share am-o Me I say, na confusion be that-o He go say he pafuka o Before-before Lagos traffic na special, eh Before-before Lagos traffic na special, eh Number one special all over the world, eh Number one special all over the world, eh You go get Ph.D. for driving for Lagos, eh You go get M.A. for driving for Lagos, eh You go get M.Sc. for driving for Lagos, oh For me for me I like am like that, eh Ah-ha-ha-ha, na my country – why not? For me for me I like am like that, eh For Ojuelegba For Ojuelegba For Ojuelegba For Ojuelegba For Ojuelegba (Lagos City) For Ojuelegba For Ojuelegba For Ojuelegba For Ojuelegba, moto dey come from south Moto dey come from north Moto dey come from east Moto dey come from west And policeman no dey for centre Na confusion be that-i o He go say he pafuka o When we talk, say confusion Everything out of control When everything out of control He go say he pafuka


Other Fela Kuti songs:
all Fela Kuti songs all songs from 1975