Fela Kuti — Ikoyi Blindness

You miss road, you miss road When you miss road, you no go reach You no go reach where you Dey go Because that not be the road oh No be the road where you For dey I say no be the road No be the road wey you for Dey You miss road, you miss road When you miss road, you no go reach You no reach where you Dey go Because that not be the road oh No be the road where you For dey I say no be the road No be the road wey you for Dey One man wey I know Him be lawyer Him go buy the thing for him work Him go buy the thing dem call spanner Wetin lawyer go take spanner do E no go reach where him Dey go One man wey I know Him be music Him go buy the thing for him work Him go buy the thing dem call hammer Wetin music go take hammer do Him no go reach where him Dey go Because that not be the road No be the road wey you for dey I say no be the road No be the road wey you for Dey Par par don doin O pa toin toin toin toin Par par toin Make you tell the lawyer say no be spanner Make you help me beg the lawyer say no be spanner Na books you for buy no be spanner Make you tell the music say no be hammer Na gocheck him for buy no be hammer Them use them sense them change them spanner and hammer Them miss road, them find road again o Papanaba to pa-in toin toin Eh eh eh Ra ra ra ra ra Eh eh eh eh This one my friend them different from the man Eh eh h This two walk I say dem different from the man Eh eh eh Them different from the man wey no see road at all Eh eh eh Wey no see rod at all, wey go stand near river Eh eh eh Na shallow him go drop o Shallow shallow him go drop I say na shallow him go drop o Shallow shallow him go drop o Shallow shallow shallow shallow shallow shallow eh eh eh Eh eh eh Make you help tell the man wey Dey stay for ikoyi Eh eh eh Make you help tell the man wey Dey stay for Ikoyi Eh eh eh From malad cross close to Atlantic Ocean Eh eh eh Wey them they for ikoyi them no see road at all Eh eh eh Wey them no see us for Mushin at all at all eh eh eh Wey them no see us for shomolu at all at all Eh eh eh Wey them no see us for ajegunle at all at all Eh eh eh Maroko nko nko them no see at all at all Eh eh eh Wey them no see us for kalakuta at all at all Shallow him go drop o Shallow shallow him go drop o Gbagaun nko Gbagaun gbagaun him go quench o Rin rin rin nko Rin rin rin blow the belt o Shallow shallow him go drop o Gbagaun gbagaun him go quench o Wirin wirin wirin blow the Knot o Shallow shallow him go drop o Gbagaun gbagaun him go quench o Wirin wirin hold blow the knot o Shallow shallow him go drop o Gbagaun gbagaun him go quench o Wirin wirin hold blow the knot o Shallow shallow him go drop o Gbagaun gbagaun him go quench o Wirin wirin blow the knot o Shallow shallow him go drop o Gbagaun gbagaun him go drop o Wirin wirin blow the knot o Shallow shallow him go drop o Gbagaun gbagaun him go quench o Wirin wirin blow the knot o ✖️ 9ce Saxophone plays 🎵🎵


Other Fela Kuti songs:
all Fela Kuti songs all songs from 1975