Fela Kuti — Overtake Don Overtake Overtake Vocal

[Chorus] I get my money Plan my plan finish Start to go for market Start to go for shopping Before I reach market nko o? Government show don enter My plan don spoil o Government show don enter My plan don spoil o [Chorus] Overtake don overtake overtake! Ah! Abeg let us get down Into another underground spiritual game Abeg, after my "paso, paso" You go dey help me end am with "wen" Because dem go hear wen, yeah! Paso, paso, paso, paso... [Chorus] Wen! When they want to call, eh When they want to call, ye When they want to call Nigerian government Dem give am name, "Federal Military Government" (Federal Military Government!) For Libya dem give am name, "Liberation Council" (Liberation Council!) For Liberia dem give am name, "Redemption Council" (Redemption Council!) For Zaire dem give am name, "Revolutionary Council" (Revolutionary Council!) Dem get different different names For different different governments But the correct name for them Na "soldier go, soldier come" [Chorus] Soldier go, soldier come! Soldier go, soldier come Federal Military Government Libya Liberation Council Liberia Redemption Council Zaire Revolutionary Council Soldier go, soldier come Soldier go, soldier come When Obasanjo and Yar'Adua Chop belly full and go Them put civilian friends for there Them shout, "Second republic!" People wey no know dey happy People wey know them dey look Dem baptize the civilian government Them name am federal government Me I know by their name Me I call them "soldier put, soldier go" [Chorus] Soldier go, soldier come! Soldier come, soldier go! Na so our lives for Africa dey roll Since them say we get independence The civilian government wey them dey Na soldier dey protect them When our lives roll small E go go knock head for wall When our lives roll small E go go knock head for tree When our lives roll small E go go knock head for stone When I see say our lives dey roll Like one yeye ball Wey one yeye wind Dey blow from one yeye corner I put my mouth for song: "Kalakuta Show" [Chorus] Yeye rolling! Gaga gugu, gaga gugu! Woko woko, woko woko! Look the man he dey waka Hungry dey run for him face I put my mouth for song: "Mr. Follow Follow" [Chorus] Yeye rolling! Mr. Follow Follow! Mr. Follow Follow, make you open eye Mr. Follow Follow, make you open sense I put my mouth for song: "Zombie o, Zombie" [Chorus] Yeye rolling! Zombie o, zombie! Zombie no go go unless you tell am to go and stop Attention, quick march, left turn Right turn, about turn, quick march Quick march, left turn, right turn About turn, quick march, left turn I put my mouth for song: "Shuffering and Shmiling" [Chorus] Yeye rolling! Suffering and smiling! Every day my people dey inside bus Forty-nine sitting, ninety-nine standing Them dey faint, them dey wake like cock Every day na the same thing I put my mouth for song: "Unknown Soldier" [Chorus] Yeye rolling! Unknown soldier! That my mama wey you kill She is the only mother of Nigeria Which kind injustice be this? Wetin concern government inside? If na unknown soldier Them turn blue into red Them turn pink into green [Chorus] Soldier go, soldier come! Soldier come, soldier go! The reason suffer our suffer He don dey show him face to us When black man want to start business, na big wahala Na big wahala, he go run orisirisi running When he start the business nko? Another wahala Another wahala, he go beg orisirisi begging To settle wahala, na to start wahala again To start wahala again you go fall orisirisi falling And things don come change again Soldier don put everybody for reverse Na back the country take dey walk Soldier don put everybody for reverse Na back the country take dey walk Soldier don put everybody for reverse Ah, I beg, we wan change the mood of this music now We wan inject second bass and the big conga drums Oya! Pop! [Chorus] Na from back! If them wan to knock your head Eh-eh, na from back o If them wan to knock your head Eh-eh, na from back o If you wan to run, be running Eh-eh, na from back o If you wan to run, be running Eh-eh, na from back o If you wan to beg, be begging Eh-eh, na from back o If you wan to beg, be begging Eh-eh, na from back o If you wan to fall, be falling Eh-eh, na from back o If you wan to fall, be falling Eh-eh, na from back o If you wan to get wahala Eh-eh, na from back o If you wan to get wahala I say, na from back o If anybody wan to try to run forward Soldier boots go kick am back Eh-eh, na from back o Ah! Oya, pass o and wen Pass o, pass o, pass o, pass o... [Chorus] Wen! Ah! Oya, second bass... pop! My friend wan come buy fan Him dey sweat for him dey sleep for room Him dey fall level of tree The fan na seventy-five naira My friend him dey follow salary Him dey try to save and save and save Every time he nearly buy the fan Government go add ten naira more Every time he nearly buy the fan Government go start one activity Till the fan reach two hundred naira My friend nearly die, he never die My friend he no wan die Die-die no dey for him dictionary For where? Huh... Him dey try to save and save again Him save for one year and six months Inside cupboard Under pillow Under, under cooking pot Inside socks Under carpet Him dey on his way to buy the fan When alarm come blow [Fela vocalizes a police siren] Government announce second tier Everything come tear to pieces Everything come expensive Even water become expensive Second bass, jare... pop! Fan don become seven hundred naira Me and my friend start to look ourselves He remain small make my friend dey cry Na laugh laugh he catch monkey Na now he come understand him life Enjoyment can never come him way Na now him life dey go reverse In Africa, him fatherland One more time... [Chorus] Soldier go, soldier come! Soldier come, soldier go! Na so Africa man life dey be Suffer don daburu him sense When you wear police uniform Na to collect money for road Abi I lie? When you wear police uniform Na to collect money for road I no dey lie! Police station don turn to bank D.P.O. na bank manager Police station don turn to bank I.G. na managing director Na big e wahala for man to waka for road at anytime So you see, my brothers Overtake don overtake overtake, eh-yah Overtake don overtake overtake, eh-yah [Chorus] Overtake don overtake overtake! Eh-yah Eh-yah Eh-yah... That my mama wey you kill She is the only mother of Nigeria Which kind injustice be this? Wetin concern government inside? If na unknown soldier Them turn blue into red Them turn pink into green [Chorus] I get my money Plan my plan finish Start to go for market Start to go for shopping Before I reach market nko o? Government show don enter My plan don spoil o Government show don enter My plan don spoil o [Chorus] Overtake don overtake overtake!


Other Fela Kuti songs:
all Fela Kuti songs all songs from 1989